BBC Africa wrote the following report in Pidgin English. According to the BBC it has been confirmed by Lagos Police.
Words BBC Africa
Police for Lagos state, south-west Nigeria say eight domestic workers of di popular Nigerian Afrobeat star, Davido na im dey answer questions over di death of im three year old son.
Benjamin Hundeyin wey confam dis to BBC Pidgin say say dem don already deposit di deadbodi of di young boy to motuary.

Hundeyin say di incident happun on Monday night and na one of di domestic workers go report for police station.
E say di parent also dey in tok wit dem and investigate dey go on.
E add say dem go release any of di eight workers wey no dey culpable at di end of dia investigate.
Tori bin dey fly up and down say drown for swimming pool wey dey im papa house for Banana Isand.
Di parent of di boy never comot to comment on di incident.
Ifeanyi be di son wey im get wit im Fiance, Chioma Rowland.
Dis dey come days afta di family celebrate di pikin third birthday wey shelle for October 20.
Some days before, e bin get one video wia Davido dey teach Ifeanyi how to swim.
For di videos wey bin trend for social media Davido bin carry di pikin make am flap im legs for di water as e dey tell am wetin to do.
Dis go be di second time wey celebrity for Nigeria go loose pikin to drowning.
For 2018, D’banj and im wife, Lineo Didi, lost dia first pikin afta e bin drown for pool